World cup results yesterday
As e dey hot for World Cup. Plenty tins dey happen as Portugal make sure say las las dem win Ghana plus oda games wey happen.
Switzerland vs Cameroon.
Bi like say all di teams wey enta dis world cup for Africa forget dia leg for house o.
As at yesterday, no African team don win any game yet.
Highlight
Portugal vs Ghana.
Ghana wey Africans don put hope ontop say go try sef fall our hand. Even tho we know say Portugal no be soft meat but unto say Africa no suppose carry last, we dey expect draw.
Na C. Ronaldo fess open floor wit penalty before Ayew from Ghana equalize am. Afta Felix from Portugal score for 78 and Leao add anoda one for 80 mins take distabilize di black stars of Ghana. Bukari try im own score for 89 mins but dem try make dem see anoda goal but e no work. Game end for 3-2 in favor of Portugal.
Highlight
Brazil vs Serbia
Brazil show Serbia say e get why dem hold record of say dem no dey lose opening match for world cup.
Comments
Post a Comment