World cup scores yesterday wit highlights
3 matches naim Dem play untop Qatar World cup 2022.
Games just start to dey tough so.
England finish Iran, even Netherlands show Senegal say, no bi say na today dem start ball. USA and Wales no do pass each oda.
Senegal vs Netherlands.
Di game tough wit draw from first minute till e reach 83mins before Netherlands score first goal.
Di extra time long no bi here, na untop 90+9 mins Klaassen drop di second goal to take end di match.
Highlight
England vs Iran
So far for dis competition, na dis game get goals pass. Infact di goals wey dey dis game pass all di goals wey dem don score for di oda 3 games.
England vex come dis competition. As Bellingham open floor for goals inside 35mins, Saka, Sterling, Rashford and Grealish sef mark register of pipo wey score for di game. Iran sef no keep quiet o as dem sef score for 65mins con still add second one for 90+13 mins. Extra time for dis world cup get as e long.
Highlight
USA vs Wales
As USA say dem no go gree, na so Wales sef tok dia own o.
None of Dem gree to bow for di oda person as dem play di first draw for inside di competition.
Na 1-1 draw end di match as dem dey look forward to better luck for dia oda games.
Highlight
Comments
Post a Comment