Brazil football legend Pele go spend Christmas inside hospital

 Brazil football legend, Pele go spend Christmas day inside hospital as him cancer don enta anoda level. 

Him medical team and family dem yarn dis gist as him dey receive treatment for di cancer wey don dey worse now still join wit kidney and heart wahala.

Di 82 years old "require make dem take care of am well untop di kidney and heart wahala wey dey ground" na so Albert Einstein Hospital wey dey Sao Paulo drop di gist.

Even as e bi say di cancer dey increase, di man no dey for intensive care.

Pele wey some pipo dey consider as di greatest player of all time, don dey hospitalize for Sao Paulo since November 29 for wetin him medical team tok say na re-evaluation of him chemotherapy treatment wey him don dey receive since di surgery wey him do to take remove one colon tumor for September, 2021.

Doctors don also diagnose Pele- wey him real name bi Edison Arantes do Nascimento- say him get respiratory infection. For di beginning of dis month, Pele daughter, Kelly Nascimento and Flavia Arantes don assure fans about di heath of dia papa as dem deny report wey bin come out before say di guy dey end-of-life care as him supporters dey outside do hospital dey do vigil


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal