Finally: France bow give Argentina
Everybody wey like football for dis life don see one tin or anoda wey concern dis FIFA 2022 final wey happen for Qatar dey part of di finals wey tough pass since den don dey play World cup finals.
Argentina vs France
France start di final game like who dem beg to con play di match as Argentina put all dia mind begin press France like pant trouser wey tailor wan put beta gator.
E nor try wey mistake happen for France box as Angel Di Maria fall inside box wey hive opportunity for penalty and Messi, deliver well. Cold first catch France. E nor too they before France defense disorganize again and Di Maria, run second enta inside di same first half.
Everywia quiet like say na so di game go end, some pipo go even believe say e for reach like 5-0 wey Argentina go land France for neck.
Second to half start, bi like say di progress of France no show, naim dia Coach Diet Deschamps make some kain make sense subs, di tin bin dey like say na ment cos how u go comot person like Giroud for dis kain game! E comot some oda players too con put sharp boiz dia. As clock enta 80mins....even France don lose hope, Argentina sef don relax, e remain small dem for don dey ask for champagne bottle.
Naim Argentina defense make mistake allow France see penalty. What?! Mbappe take am wit all im mind and di next minute e see beta chance to take slice anoda shot enta, di guy no tink am twice. Wetin bi don reach Argentina hand jus drop for ground as di game con bi 2-2 draw.
Choi! Argentina start to dey weak, crying start, ha! Shey na so e go end? France for di oda side jus dey ginger like who jus high.
90mins finish, everybodi eye clear...na extra time don show like dis o. Omo....game start, two teams dey see chances dey lose am, tension jus high like full electric current.
Na so anoda opportunity enta for Argentina inside di second half of di extra time and Messi knock am again....Omo....everywia scatter. Ha!!!! France wan mad. Which kind shit bi dis, e go hard packers to pack o. E nor too they, anoda blunder for Argentina box, penalty for France, again!!! Ha! Today na today. Na so Mbappe score hat-trick for world cup final o.
Na so di game enter penalty. Na for here Argentina take show say, we sabi dis one pass una.
Las las, even as e bi say Argentina nor start well, Dem makes sure say dem finish gallantly well.
Congratulations to Argentina. Di new world football champions dem!
Highlight
Penalty
Comments
Post a Comment