One Supercomputer don predict how FIFA 2022 world go go bi o

 One supacomputer don predict how di Qatar 2022 world cup go bi o. As di supa computer from BonusCodeBets yarn, France go beat England for quarter final wey dey wan play so.


Morocco go fall against Portugal wey go con make France and Portugal meet for Semi final. 

For di oda side, Argentina go flog Netherlands as Brazil go wipe Croatia wey go con make di Semi final for dis side bi Argentina vs Brazil.

Di computer still talk go front say, Brazil go wipe Argentina as Messi side go wave goodbye give world cup final as Portugal sef go collect from France hand.

E go con bi France vs Brazil for Final but las las, Na Brazil go win am.


Na as di supa computer see am bi dat o. Make we dey observe if na so e go really bi

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal