Round of 16 day 2
Di big boys don dey gather for inside Qatar 2022 as France flog Poland with beta koboko and England wipe Senegal oraimo cord for neck.
We Neva see any of di upsets wey happen for group stage for dis quarter finals o. Bi like di men don dey really dey separate demself from boys.
France vs Poland.
Na Qatar we still dey wey plenty tins still dey happen as France show Poland who di man bi.
Giroud naim fess open di goal scoring yesterday evening as e drop first goal for inside 44mins before Mbappe wey score two goals yesterday drop im own for 74 and 90+1.
No bi say Poland sef no try o. Dem sef try, make e no bi like say dem no see goal for dis round. Lewandoski score dia only goal wey bi penalty kick inside 90+9 mins wen stadium don almost close gate.
Highlight
England vs Senegal.
Africans bi don start fasting and prayer untop Senegal head make e bi say, England go lose di game but sometimes no bi by who im prayer loud pass. Na who God wan answer naim Baba God go answer o. England cook Senegal like goat meat peppersoup as dem knock Dem 3 hot goals.
Highlight


Comments
Post a Comment