Round of 16 day 3
No bi small tin o. Croatia don ja Japan comot for di FIFA 2022 world cup wey dey happen for Qatar as Brazil discipline South Korea like who dey discipline small pikin.
Japan vs Croatia
Japan try no bi small. Na Dem even fess score as dem try drag do quarter finals ticket wit Croatia but Croatia con manage see equalizer o.
Two of dem begin drag di ticket till dem drag am reach penalty wey con make Croatia win Japan. Japan don kukuma pack dia load comot Qatar face dia country Jejely
Highlight
Brazil vs South Korea.
Brazil flog South Korea like who dey discipline small pikin. Brazil score 4 hot goals before South Korea manage score dia own wen match don almost finish
Brazil don port go next round like dis.
Highlight


Comments
Post a Comment