Round of 16 last games

 Morocco shock everybodi o as Spain hear am loud for Morocco hand. Portugal set crucify Switzerland as Ronaldo dey bench for di match.


Morocco vs Spain

Spain collect from Morocco hand as Morocco win Dem ontop penalty mata.

Di game wey last for 90mins+extra time wit 0-0 as di two teams no gree for each oda but na penalty dem con use settle di mata.


Morocco don enta quarter finals so as di only African team wey make am inside quarter finals for dis world cup.


Highlights



Portugal vs Switzerland

Portugal dismantle Switzerland as dem flog dem 6-1. Even as e bi say Ronaldo dey bench, Switzerland still collect wit dia two hands.


Na Portugal and Morocco go con face each oda for Quarter Finals so.


Highlight



Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal