Round of 26 update as e dey go

 Round of 16 don start yesterday and di dust for Qatar bi like say e don dey settle down.

Na here we take separate boys from men.

Netherlands show USA who really bi man and Argentina make Australia realize say den no bi mate.


Netherlands vs USA

Netherlands nor waste time at all as den don sabi say for dis stage if you dull, you don go be dat (otilor).


Netherlands sharply score for 10 mins and add anoda one for 45+1 mins as dem lead 2-0 for first half. For second half inside 76mins, USA score as Wright run am to give dem hope say tins fit still happen but Dumfries no gree o as d guy seal di win wit 3rd goal for Netherlands 5 mins afta USA score dia own.


Netherlands don enta quarter finals.


Highlight





Argentina vs Australia

Argentina sabi say if dem dull dis one like dem do with Serbia for first game for inside group stage, na to dey go house bi dat. Dem sharply organize to show Australia say Man and boy no bi di same tin.


Na Messi first open goals for di match before Alvarez top am. 


Highlight




Argentina sef son join for quarter finals wit dis win so.




Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal