World cup: Last group games wey happen yesterday.

 Ghana don comot for world cup as dia na beating Uruguay beat dem di second time. Na swell swell eye Ghana take comot. Both Ghana and Uruguay, none of dem qualify.

Cameroon sef shock Brazil as dem score for extra time.


Cameroon vs Brazil

Brazil go don dey hope say na only dem go get 9 points for di group stage for dis world cup but dem no no say Cameroon get dem for mind.


Di shocker goal from V. Aboubakar enta for 90+2 mins as di guy even use head carry red card di next minute unto say im comot shirt as di guy don get yellow card before con join anoda yellow to make am RED .

Highlight





Serbia vs Switzerland

Na di result of dis game make Cameroon comot for inside world cup so o. As dem go don dey hope same make draw shelle but Switzerland nor gree at all.



As Serbia dey drop am, Switzerland dey return am, until wen e bi say Switzerland con drop di third one, Serbia liver no carry am to return am give dem.


Highlight




South Korea vs Portugal

South Korea show up again to mark am for register say, no bi play den come dis competition come play.


As Portugal score first goal inside 5 mins, dem tink say na like oda games say dem don win am already. South Korea say, 'Portugal, hold my beer'! Na di beer dey Portugal hand wen South Korea put two hot goals for dia bodi.


Highlight




Ghana vs Uruguay

For dis life ehn, if person don beat u before and una get opportunity to meet again, not go dey tell am say u wan revenge! Na dat revenge go cover ur eye, u no go see road well. Ghana even lose penalty for di game.

Naim make Ghana see beating again for Uruguay hand o but dis time, both di winner and di loser, none of dem progress enta next round. Di game jus bi like to show say Uruguay nor bi Ghana mate, even if Dem meet for inside moon.


Highlight





Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal