World cup: teams wey don qualify

 Group stage games dey end dis night so as we dey enta round of 16 wey bi knock out for di 2022 world cup.


Group E

Japan shock everybody as dem win Spain! Pipo don dey hope say maybe Spain go win Japan make Germany for see road qualify but Wetin happen different.




Even Spain na goal difference epp dem. Dem for don dey road back to Espanol as we dey tok so.


Group F

For group F, as Morocco win Canada dem catapult go enta top position for di group as Belgium comot for di competition.

Canada no even see single point for inside di whole competition.


Group C

For  group C, Argentina and Poland na Dem qualify as Saudi Arabia wey fess dey jubilate untop dia win for di first game against Argentina don comot for inside di competition.


Na even goal difference Poland take qualify, na small remain dem for nor enta next round.



Group D

E dey unfortunate say Tunisia no qualify even afta dem beat France for dia last game.

Dem go use di winning against France hold bodi.



Na France and Australia qualify comot to next round for di group.


Dis world cup no bi moimoi. Who u tink say go qualify fit chop beta beating by team wey small pass am!



Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal