Young Portugal player, Ramos dey step inside Ronaldo shoe

Goncalo Ramos enta im first world cup game and di guy perform wetin bi like magic. Sometin wey suppose hard, di guy make am soft as e score 3 goals for Portugal for dia round of 16 game against Switzerland on tuesday. Di game bi im first world cip appearance and di guy deliver more dan expectation. Na Ramos replace Christiano Ronaldo for di game and im score hat trick to put di country forward go quater final as dem crush Switzerland 6-1 for di game wey make dem register dia place for di quater final hame against morroco on saturday.
Dem call am "pistolero" bcos of di way wey e take celebrate. Ramos wey don dey enta pipo eye now play im first country match wit Portugal wen dem play friendly wit Nigeria before Qatar 2022 world cup start. For di friendy match wey Portugal win 4-0, Ramos provide assist even as e bi say dem carry am enta as subsitute. As tins bi now e bi like say di guy don dey prepare himself as replacement for C.Ronaldo. Afta dem announce am as man of di match, Ramos yarn say "him no even dream am say him fit ever score 3 goals for im first world cup game wey com still bi knockout stage" Na di first time for inside di last 16 years wey Portugal go put Ronaldo for bench and e fit happen again on saturday as di Benfica striker, Ramos don dey part of di pipo wey go start game wit morroco on Saturday.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal