Week of steady beating for Chelsea
For di last one week na from one beating or di oda Chelsea dey move from.
Na Man-City fess start to dey deal wit dem, Dem first beat dem for home for EPL game,1-0. Na Mahrez score di only goal for dat game wey happen for 63 mins and Man-City collect full 3 point for Chelsea hand inside Stanford bridge.
E no too tey again, di two of dem meet for 3rd round of FA, e con bi like say dem use Man-City dey torment Chelsea.
Naim Man-City nak dem again but dis time, na 4 goals City put for Chelsea lap.
Dem no even pity say e go get how Chelsea fans or di club go feel, Dem make sure say dem beat Chelsea two times within 4 days
Dis time Mahrez score two times as Alvarez and Phil Foden add one one join.
As all dis tins dey happen, Fulham jus peng for one side unto say na dem bi Chelsea next game o. Hope say Chelsea no go carry dia grudge wit Manchester City con meet Dem for London like dis.
But as Fulham dey reason am, Dem dey plan too, even Chelsea dey get mind say dem go use Fulham wipe yansh make dem for take see dia name redeem small.
Fulham don go behind Chelsea back go collect small lecture from City, as dem meet Chelsea, Dem don know Wetin dem suppose do. Las las, Chelsea collect both beating and red card for Fulham hand. Dia eyes peel comot for stadium.
Now na Crystal Palace bi dia next game later today, even di fans don taya to do fasting untop Chelsea mata, make e no jus turn to hunger strike as dis Chelsea team is not Chelsea-ing
Comments
Post a Comment