Posts

Showing posts from March, 2023

Tottenham go decide Conte future in the next 48hours

Image
 Antonio Conte believe say some players dey wey like to dey dia comfort zone, even if na Angel Gabriel bi di coach.  Conte still believe say if di future for any club no align, di club no go fit make am. Gist dey street say e go hard for Conte to continue as Tottenham head coach after di guy para anyhow afta dia 3-3 draw wit Southampton on saturday. Informate from pipo wey near Conte come out say, Conte no tok wetin him tok on Saturday because e wan make Tottenham sack am but him tok am unto say di mata don dey him belle for long and nor bi to make any player feel anyhow. Na end of di season Conte contract go end but as tins bi now dem fit show di guy exit before dat time. As international break dey dis weekend, Conte don go back to him house for Italy to go relax. Di guy dey always try to sharply align wit him winning mentality but him dey disappointed say him neva see am do for Tottenham.

Wetin dey happen for La-Liga table

Image
 Na here we dey o, make we update una about how table bi for Spain as we dey tok so. Wit dia winning on Sunday, Barcelona don use long pole create gap between dem and Real Madrid as na 12 full points dem take dey lead for untop table now. Barcelona dey cruise untop wit relax mind. Celta Vigo hold di table for middle inside 10the position as Mallorca dey number 1 for di second half of di table. Di gang of Valencia, Almeria and Elche na dem dey bottom of table dey plan how dey wan run dia relegation party!

La liga for weekend (Sunday)

Image
 Dis weekend wey jus pass so, make we use dis one touch light wetin happen for Spanish football. Real Betis vs Mallorca: Real Betis flog Mallorca wit jus one goal to secure 3 points for dia home. Di goal enta 3 mins after dem enta second half as Iglesias Quintas put am for Mallorca bodi. Osasuna vs Villareal Even   as e bi say na Osasuna dey home, Villarreal still use dia eye see shege. Na Chukwueze fess start am wit him goal for inside 14 minutes. Na after game dey near to close Morales sef drop him own, but dis time na double di guy drop. One for 85mins and do oda one for 90+3mins. Di game end for 0-3. Sociedad vs Elche Sociedad show Elche say, oga, naim den dey call 'master'! As dem flog di visitors 2 goals to nothing. Di game bin dey barren of goals for first half but as second half start, Kubo end di barrenness as Barrenetxea top am for 90mins to seal am for 2-0. Getafe vs Sevilla: Getafe   welcome Sevilla come dia home to come give dem small beating to secure dia 3 points

How EPL bi right now.

Image
 Arsenal still dey cruise untop di Premier League table as di odogwu for dis season Man-City dey for Arsenal throat as dem dey give Arsenal close marking, if Arsenal try fuck up like this, Man-City go overtake dem. Man-United and Tottenham dey with Arsenal and Man-City for top 4. Chelsea and Aston Villa na dem dey hold middle of table. Chelsea dey last for top 10 as Aston Villa dey first for last 10. Southampton, Bournemouth and Westham struggle for di bottom of the League.

Arsenal dey top as Chelsea dey struggle for middle of table

Image
 EPL still dey go as e suppose go. Chelsea vs Everton Chelsea still dey struggling zone as dem no get liver to beat Everton yesterday. Do mata end for draw as Everton equalize dem close to di end of do match. Arsenal vs Crystal Palace Arsenal still dey show other teams for EPL say, na we dey here dis season. As den win 4-1 for dia game today.

Liverpool roast Man-U like barbecue

Image
 Wen mata don pass cry, na laugh dem dey laugh put o. Na wet in happen to Manchester United untop dia visit go Liverpool dis evening bi DAT o. Na small e remain, Ten-Hag boys for collect reach 10 as goals begin dey from Gakpo, to Nunez to Salah wey make sure say dem score 2 goals each before Firmino drop di final one inside 88 mins. Na Manchester United player and fans know how dem wan take sleep dis night o. Dia back go don fry. Highlight