Dis weekend wey jus pass so, make we use dis one touch light wetin happen for Spanish football. Real Betis vs Mallorca: Real Betis flog Mallorca wit jus one goal to secure 3 points for dia home. Di goal enta 3 mins after dem enta second half as Iglesias Quintas put am for Mallorca bodi. Osasuna vs Villareal Even as e bi say na Osasuna dey home, Villarreal still use dia eye see shege. Na Chukwueze fess start am wit him goal for inside 14 minutes. Na after game dey near to close Morales sef drop him own, but dis time na double di guy drop. One for 85mins and do oda one for 90+3mins. Di game end for 0-3. Sociedad vs Elche Sociedad show Elche say, oga, naim den dey call 'master'! As dem flog di visitors 2 goals to nothing. Di game bin dey barren of goals for first half but as second half start, Kubo end di barrenness as Barrenetxea top am for 90mins to seal am for 2-0. Getafe vs Sevilla: Getafe welcome Sevilla come dia home to come give dem small beating to secure dia 3 ...