Paul Pogba and im broda mata don enter gear 5 o as Matthias don drop fresh updates

 Una go remember say we drop gist about di wahala wey Paul Pogba and I'm broda dey inside wey don cause plenty gbege as e don drag oda pipo enta di mata.



We don receive update now say di mata don thick pass as e bi before as Mattias Pogba wey bi Paul Pogba drop gist even as e bi say e dey inside prison.

Mattias release some video still drag Nottingham Forest defender Serge Aurier say na im introduce im broda to di native doctor wey dey collect between €75,000 and €100,000 from Paul Pogba hand, two times a month.

As e dey detention sef no stop di guy from dropping gists o. E drop some videos wey some pipo talk say na plan as di video bi like say dem don record am before dem arrest am so.

Mattias say Paul don cement im relationship wit di native doctor and dis same native doctor and French international footballer, Allou Diarra, na padi dem bi.

"Dis person wey una dey call my broda don align himself wit witchcraft as e don dey follow native doctor and no bi today e start. Di name of di native doctor na Marabout Ibrahim aka Grande. My broda dey use juju curse some players including Mbappe, i no con know if na jealousy or na because e wan win match. Dat my broda Paul, no bi beta person"

E still continue to yarn say " Everybodi eye go clear to see dia mata well. E go clear like R-Kelly mata. To popular no mean say person na beta person"

As di mata dey hot so, Paul Pogba don dey under police protection since di gist enter street even dia mama join for di police protection since dem find out say di bad guys bin pressure her make she tell Paul Pogba to pay dem.

Paul sef tok im own say, im broda, Mattias dey part of di gang wey dey worry im life, e still get some area pipo wey den gather grow up dey inside di gang too.


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal