Posts

EPL:Sunday Football gist

Image
Games for dis Sunday don start alreadi o as Arsenal don dey slice Brentford like sliced bread for Brentford house o. Na half time dem dey so. We go drop as e take happen after di game don finish later for dis afternoon. D oda game wey go still happen today na  between Everton and Westham for 2:15pm dis afternoon. Di oda ones wey bi Manchester United vs Leeds and Chelsea vs Liverpool don enter postponement as dem shift dem go front.

EPL: Wetin happen for today game

Image
  Wolverhampton Wonderers vs Manchester City Man City nor dey smile at all o. Dem go Wolves house go roast dem, dem nor even allow wolves breathe at all na from di first minute di flogging start. Na back to back jus dey drop di goals as e dey hot. Wolves cool down chop 3 goals for Man City hand dis afternoon. Na Grealish (1min), Haaland (16mins) and Foden (69mins) join bodi take cause di kasala untop Wolves head. Newcastle vs AFC Bournemouth Na draw dis mata take end o. Na Billing firs open floor wit goal for 62 mins before Isak return am for 67mins after foul happen wey lead to penalty for dem. Di two of dem get strong head. One no gree bow for di oda. Tottenham vs Leicester Na rain of goals dis evening as Tottenham vex say why Leicester go fess dem score. As di goal enter from Leicester, Na so Tottenham go open store of goals. Fire Leicester 6 without looking back as Leicester struggle to get two befoe di mata end. Na as EPL table dey dis evenin bi dis so. Na for goal.com dis tab...

Games wey dey happen today

 Games for Saturday 17th September, 2022. For English Premier League. Wolverhampton Wonders vs Manchester City (12:30pm) Brighton&Hove Albion vs Crystal Palace (dem don shift am go front)  Newcastle United v AFC Bournemouth (3:00pm) Tottenham Hotspur vs Leicester City (5:00pm) For Spanish La Liga Mallorca vs Almeria (1:00pm) Barcelona va Elche (3:15pm) Valencia va Celta Vigo (5:30pm) Athletic Bilbao vs Rayo Vallecano (8:00pm) For Italian Seria A Bologna vs Empoli (2:00pm) Spezia vs Sampdoria (5:00pm) Torino vs Sassuolo (7:45pm) For German Bundesliga Augsburg vs Bayern Munich (2:30pm) Bayern Leverkusen vs Werder Bremen (2:30pm) Borrusia Dortmund vs Schalke 04 (2:30.pm) VfB Stuttgart vs Eintracht Frankfurt(2:30pm) Borrusia Monchengladbach va RB Leizpig (5:30pm)

EPL: wetin happen yesterday

Image
 Una welcome again to dis fine Saturday morning as EPL don resume dis week. Yesterday night, 2 games happen. 1.  Aston Villa vs Southampton. Southampton go Villa house yesterday go  chop koboko as villa show dem say dem no bi mate. Di goal from Villa enter for 41 mins inside first half. Match details dey here so. 2.  Nottingham Forest vs Fulham No bi smal tin for Nottingham yesterday as dem struggle wit Fulham to make sure say dem win for home, but as agba wey Fulham bi, dem say, e no go happen! Na so dem drag Nottingham for dia own Forest o. Awoniyi (11mins) open floor for Nottingham as dem lead for first half, for dia mind, e don soft! As second half start, Fulham don go charge dia battery, con dey score back to back like say na monkey post dem dey play. 3 goals enter inside 6 mins. Nottingham shock say, shoo! Dem hustle try see if miracle fit happen but na only one dem fit add join to make am 2-3. Las las. Fulham win dem.

EPL don resume

Image
  After di weekend break wey dem take honor Queen Eliza last week, EPL don start again dis evening as some clubs go dey follow each oda drag... Aston Villa vs Southampton Notingham Forest vs Fulham ...dis two games go start by 8pm dis night so. Unto dis new update, we dey advise everybodi wey bin don dey handle remote make dem submit am to di right pipo make kasala no for burst.

Tobi Amusan, Ese Brume don meet with President Buhari as e dash di team 200million naira

Image
 Di President of Naija, Buhari don give team Nigeria 200 million naira as dem do well for commonwealth games. Dem still give dem different honor to show say dem don get level for di country As Femi Adeshina wey bi talk talk for di President yarn, E say Pressy don put hand say make dem share 200 million naira give all of dem wey represent we country. Na on Thursday of dis week wey dey fold carpet go so Pressy give dem di award for inside Aso villa for Abuja. For di competition, Naija win 12 gold, 9silver and 14 bronze medal wey make di total medal bi 35 wey dem collect. For all di African country wey show for di game, na Naija try pass. On di overall medal table, Naija bi no 7.  Buhari award Tobi Amusan wey win gold for 100m hurdles con still break record wit  Officer of the Order of the Niger OON. Other athletes wey win medals for di game; Ese Brume, Blessing Oborodudu, Oluwafemiayo Folashade, Taiwo Liadi, Ikechukwu Obichukwu, Bose Omolayo, Favour Ofili, Nasiru Sule, Ifec...

Europa: Wetin happen yesterday.

Image
Na di tori of wetin happen for some of di matches for Europa yesterday bi dis. Roma vs HJK Helsinki Roma no smile at all as dem show HJK say, dem no bi dia mate, Roma use 3 solid goals take wounjure HJK sotey, dem sinki as dia name bi. Na Dybala, Pelegrin and Belotti join bodi take cause di kasala. Sheriff vs Man U As Man U no qualify for Champions League so, dem wan try show Europa pipo pepper.  As dis na C. Ronaldo first Europa, di guy sef mark register wit goal (pk) for inside di game wia dem show Sheriff say Oga na master. Sancho and Ronaldo join bodi for di woundment wey Sheriff collect to make am 2 wey Man U take win dem so. Braga vs Union Berlin Di two of dem bin fight tey as Braga no wan gree, Union Berlin sef say dem get coconut head. Las las, na Braga still con collect di shine o as dem see one goal smuggle enter for 77mins before di game end. Na Olivera nai do di magic wey make Braga finally fit brag untop di mata. Real Betis vs Ludogorets E get dis game bi dat yesterday...