Champions League match day!
Today na today o as anoda Uefa Champions League match dey happen dis evening across Europe. Different teams go dey hustle points today and tomorrow make dem for join teams wey go qualify go next round. Some teams don get peace of mind as dem don already win 3 games, some mind still wan cut as e bi say dem neva know how tins wan bi. Di games for today na; AC Milan vs Chelsea. 08:00pm Chelsea go go Milan dis evening to see if dem go fit continue dia winning to take move from second to first ontop dia group table as AC Milan sef go try to win make dem sef for fit go up comot for 3rd position PSG vs Benfica. 08:00pm Dia last game, PSG bin dey front until mistake happen and dem score demself own goal to make 1-1 last week. As PSG dey home, dem go try say make dem see 3 points round am up to 10 and Benfica sef no go wan gree. Dortmund vs Sevilla. 08:00pm Dortmund sef go wan nak Sevilla as e bi na na only 1 point sevilla get and na Dortmund house de...