Posts

One Supercomputer don predict how FIFA 2022 world go go bi o

Image
 One supacomputer don predict how di Qatar 2022 world cup go bi o. As di supa computer from BonusCodeBets yarn, France go beat England for quarter final wey dey wan play so. Morocco go fall against Portugal wey go con make France and Portugal meet for Semi final.  For di oda side, Argentina go flog Netherlands as Brazil go wipe Croatia wey go con make di Semi final for dis side bi Argentina vs Brazil. Di computer still talk go front say, Brazil go wipe Argentina as Messi side go wave goodbye give world cup final as Portugal sef go collect from France hand. E go con bi France vs Brazil for Final but las las, Na Brazil go win am. Na as di supa computer see am bi dat o. Make we dey observe if na so e go really bi

Round of 16 last games

Image
 Morocco shock everybodi o as Spain hear am loud for Morocco hand. Portugal set crucify Switzerland as Ronaldo dey bench for di match. Morocco vs Spain Spain collect from Morocco hand as Morocco win Dem ontop penalty mata. Di game wey last for 90mins+extra time wit 0-0 as di two teams no gree for each oda but na penalty dem con use settle di mata. Morocco don enta quarter finals so as di only African team wey make am inside quarter finals for dis world cup. Highlights Portugal vs Switzerland Portugal dismantle Switzerland as dem flog dem 6-1. Even as e bi say Ronaldo dey bench, Switzerland still collect wit dia two hands. Na Portugal and Morocco go con face each oda for Quarter Finals so. Highlight

Round of 16 day 3

Image
 No bi small tin o. Croatia don ja  Japan comot for di FIFA 2022 world cup wey dey happen for Qatar as Brazil discipline South Korea like who dey discipline small pikin. Japan vs Croatia Japan try no bi small. Na Dem even fess score as dem try drag do quarter finals ticket wit Croatia but Croatia con manage see equalizer o. Two of dem begin drag di ticket till dem drag am reach penalty wey con make Croatia win Japan. Japan don kukuma pack dia load comot Qatar face dia country Jejely  Highlight Brazil vs South Korea. Brazil flog South Korea like who dey discipline small pikin. Brazil score 4 hot goals before South Korea manage score dia own wen match don almost finish Brazil don port go next round like dis. Highlight

All di world cup finals wey don happen since 1930

Image
 Since world cup start for 1930. Na different tins don happen. Difference teams don win am and di world cup excitement loud today as e loud for 1930. Di score for world cup final since 1930 1930- Uruguay 4- 2 Argentina  1934-  Italy 2 - 1 Czechoslovakia 1938-. Italy 4 - 2 Hungary 1950-. Brazil 1 - 2 Uruguay 1954-. West Germany 3 - 2 Hungary 1958- Sweden 2 - 5 Brazil 1962-. Brazil 3 - 1 Czechoslovakia 1966-. England 4 - 2 West Germany 1970-.  Brazil 4 - 1 Italy 1974-.  West Germany 2 - 1 Netherlands 1978-.  Argentina 3 - 1 Netherlands 1982-.  Italy 3 - 1 West Germany 1986-.  Argentina 3 - 2 West Germany 1990-.  Argentina 0 - 1 West Germany 1994-.  Brazil (3) 0 - 0 (2) Italy 1998-.   France 3 - 0 Brazil 2002-.   Brazil 2 - 0 Germany 2006-.   France (3) 1 - 1 (5) Italy 2010-.   Spain 1 - 0 Netherlands 2014-.   Germany 1 - 0 Argentina 2018-.   France 4 - 2 Croatia 2022-.  ...

Round of 16 day 2

Image
 Di big boys don dey gather for inside Qatar 2022 as France flog Poland with beta koboko and England wipe Senegal oraimo cord for neck. We Neva see any of di upsets wey happen for group stage for dis quarter finals o. Bi like di men don dey really dey separate demself from boys. France vs Poland. Na Qatar we still dey wey plenty tins still dey happen as France show Poland who di man bi. Giroud naim fess open di goal scoring yesterday evening as e drop first goal for inside 44mins before Mbappe wey score two goals yesterday drop im own for 74 and 90+1. No bi say Poland sef no try o. Dem sef try, make e no bi like say dem no see goal for dis round. Lewandoski score dia only goal wey bi penalty kick inside 90+9 mins wen stadium don almost close gate. Highlight England vs Senegal. Africans bi don start fasting and prayer untop Senegal head make e bi say, England go lose di game but sometimes no bi by who im prayer loud pass. Na who God wan answer naim Baba God go answer o. England cook...

Round of 26 update as e dey go

Image
 Round of 16 don start yesterday and di dust for Qatar bi like say e don dey settle down. Na here we take separate boys from men. Netherlands show USA who really bi man and Argentina make Australia realize say den no bi mate. Netherlands vs USA Netherlands nor waste time at all as den don sabi say for dis stage if you dull, you don go be dat (otilor). Netherlands sharply score for 10 mins and add anoda one for 45+1 mins as dem lead 2-0 for first half. For second half inside 76mins, USA score as Wright run am to give dem hope say tins fit still happen but Dumfries no gree o as d guy seal di win wit 3rd goal for Netherlands 5 mins afta USA score dia own. Netherlands don enta quarter finals. Highlight Argentina vs Australia Argentina sabi say if dem dull dis one like dem do with Serbia for first game for inside group stage, na to dey go house bi dat. Dem sharply organize to show Australia say Man and boy no bi di same tin. Na Messi first open goals for di match before Alvarez top am....

Round of 16 starting today.

Image
 Round of 16 dey start today as different counties go behind face one anoda again. No testing microphone for dis one, if Dem beat u, na house straight. Di games go start dis evening go reach Tuesday. 8 games, 16 teams! Make di team wey beta pass win.