Posts

Showing posts from November, 2022

World cup table after group game don finish - Group A

Image
 Na so di table bi for group A afta dem don play dia 3 games finish. Netherlands and Senegal Qualify to move to next round as Ecuador and Qatar wey bin play first game of di competition don sink inside di boat so. Oda teams go dey play dia games today...

World cup result for yesterday and monday

Image
Dis week Monday na serious business day for Africans for di world cup wey dey play so as  Cameroon see draw wit Serbia and Ghana flog South Korea. Portugal vs Uruguay Portugal make sure say dem no dull at all for di 2 games wey dem don play so far. 6 points don dey ground already for dem as dem dey top dia group and qualification don set for dem. Highlight Brazil vs Switzerland Brazil win Switzerland for dis one as Casemiro score di only goal for di game near 90 mins. Di South American country don ensure dia place already for next round wit dis win so. Highlight South Korea vs Ghana Ghana make outstanding comeback as dem give South Korea back to back. S/Korea bin don dey lead 2-1 even as na Ghana fess score but Ghana equalize dem still come make sure say dem beat dem. Di game na anoda boost for African countries for dis year world cup. Highlight Cameroon vs Serbia Serbia and Cameroon no gree for each oda as na draw dem take finish. las las  Cameroon see draw for di game after Serbia bi

World cup results for weekend

Image
Di weekend tough for Qatar 2022 world cup as many tins shelle. Mighty teams no gree each oda. Australia vs Tunisia Australia rub pepper for Tunisia eye for weekend as dem beat di African team 1-0 to secure 3 points for demself. For dis world cup, Tunisia Neva win any match so. Dia hope say den go reach next round don dey fade. Poland vs Saudi Arabia. Saudi Arabia don see who pass dem as Poland show dem shege. Dem beat Saudi as Zielenski and Lewandoski nak dem goals. Saudi go dey hope say make dem see one more win for dia last game make Dem for take qualify to next round. France vs Denmark France show again why dem bi defending champion as dem show Denmark say oga na master. Mbappe naim score di two goals and Christensen score one for Denmark. Highlight Argentina vs Mexico Argentina win dia first game for di world cup as dem win mexico wit 2 goals. Messi and Fernandez score di two goals. Argentina don get dia own 3 points now. Highlight Japan vs Costa Rica Costa Rica fall Japan hand as

World cup results for yesteray

Image
Yesterday na special day for Africa for di ongoing world cup as na yesterday African country see dia first win. Senegal make sure say, Qatar see shege for dia hand plus oda games wey happen. Wales vs Iran Wales collect for Iran hand yesterday as Iran show dem say forget say wetin happen o. Na flog we go flog una today. Dis world cup so far, notin wey u fit use hand beat chest to predict o. Di two goals happen for extra time afta 90 mins don pass. First one na for 90+8mins and second one na for 90+11mins. Highlight Senegal vs Qatar Senegal use Qatar head mop di whole stadium yesterday as dem give Qatar beta beating. Dem no even pity dem as host country. But at least Qatar see dia first goal for di tournament inside di match to console dem. Na from 41 mins goals start to dey rush for di game. Highlight Netherlands vs Ecuador Ecuador show say dia first game wey dem win no bi say na unto say Qatar no sabi play o. Dem sef come dis World Cup con show say dem get doings. Netherlands fess scor

World cup results yesterday

Image
 As e dey hot for World Cup. Plenty tins dey happen as Portugal make sure say las las dem win Ghana plus oda games wey happen. Switzerland vs Cameroon . Bi like say all di teams wey enta dis world cup for Africa forget dia leg for house o. As at yesterday, no African team don win any game yet. Na Switzerland still flog Cameroon 1:0 as Embolo rub aboniki for dia eye take carry 3 points for group G. Highlight Portugal vs Ghana. Ghana wey Africans don put hope ontop say go try sef fall our hand. Even tho we know say Portugal no be soft meat but unto say Africa no suppose carry last, we dey expect draw. Na C. Ronaldo fess open floor wit penalty before Ayew from Ghana equalize am. Afta Felix from Portugal score for 78 and Leao add anoda one for 80 mins take distabilize di black stars of Ghana. Bukari try im own score for 89 mins but dem try make dem see anoda goal but e no work. Game end for 3-2 in favor of Portugal. Highlight Brazil vs Serbia Brazil show Serbia say e get why dem hold recor

Arsene Wenger don predict team wey go win dis year world cup

Image
 Former Arsenal boss Arsene Wenger don yarn say im go like see France say den win dis world cup. Im believe say di defending champions get di liver plus kidney to take run am. Many teams dey di competition wey strong well well, teams like Argentina, Spain, Brazil and even Germany dey part of di teams wey pipo believe say go win am. But Wenger believe say di Didier Deschamps side get Wetin e take to take win am back to back.

World cup results yesterday wit highlights

Image
 World cup still dey continue hot hot as some teams wey normally person go use mind write off dey do big tins. Na Saudi first embarrass Argentina, now na Japan finish Germany. Bi like say no big team again like that o and small team sef no wan dey dis world cup. Belgium vs Canada. Normally you go tink say Canada suppose chop plenty for Belgium hand but na lie, na one goal Belgium manage to score dem from di hand of Bashuayi. At least Belgium don get 3 points for group F so. Highlight Spain vs Costa Rica Oga na master o, who senior you don senior you and e nor get notin wey you fit do about am, na Wetin happen for dis match bi dat o as Spain use koboko wipe Costa Rica like say na loan Dem take come World cup. 7 hot goals for only one side make Spain di team wey don score di highest goals for dis competition so far. Highlight Germany vs Japan. Anoda shocker happen yesterday as if to say di one wey we see on Tuesday between Saudi Arabia and Argentina neva reach! Japan shock everybody as d

World cup game results for yesterday.

Image
 Saudi Arabia shock everybody as dem deal wit Argentina. Di first 2 goalless draw sef happen for dis tournament yesterday and France show Australia wetin den dey call football. France vs Australia Australia collect wotowoto from France hand yesterday for dia match yesterday night. France wey bi defending champions scatter ground wit goals as dem drop four hot goals inside Australia pocket. Na Australia first start to score before France vex scatter everywhere wit goals. Highlight Mexico vs Poland Mexico and Poland no gree for each oda as na draw dem take finish dia game yesterday. Na do second game wey go get goalless draw so far for inside dis competition. Highlight Denmark vs Tunisia Denmark and Tunisia struggle with each oda, Dem even score goals wey bi offside for di game but las las, na draw end am. Na dia game bi do first goalless t for di competition. Highlight Argentina vs Saudi Arabia Saudi Arabia shock di whole world yesterday as dem flog Argentina 2-1. Even Messi no believe

World cup scores yesterday wit highlights

Image
 3 matches naim Dem play untop Qatar World cup 2022. Games just start to dey tough so. England finish Iran, even Netherlands show Senegal say, no bi say na today dem start ball. USA and Wales no do pass each oda. Senegal vs Netherlands. Di game tough wit draw from first minute till e reach 83mins before Netherlands score first goal. Di extra time long no bi here, na untop 90+9 mins Klaassen drop di second goal to take end di match. Highlight England vs Iran So far for dis competition, na dis game get goals pass. Infact di goals wey dey dis game pass all di goals wey dem don score for di oda 3 games. England vex come dis competition. As Bellingham open floor for goals inside 35mins, Saka, Sterling, Rashford and Grealish sef mark register of pipo wey score for di game. Iran sef no keep quiet o as dem sef score for 65mins con still add second one for 90+13 mins. Extra time for dis world cup get as e long. Highlight USA vs Wales As USA say dem no go gree, na so Wales sef tok dia own o. Non

US Presido, Joe Biden don send message give American team

Image
 Di Presido, Joe Biden send strong message give di USA team for call wey im make to dem as dem wan start dia game for dis world cup for Qatar. Di Presido tok say even tho America team bi like say dem bi underdog for football mata, I'm know say dem go fit shock di world and win di title if dem play togeda well. Im say, America dey wit di players and dia family and everybodi for dia go like to see say dem win so make dem play wit all dia heart to take make America proud. "Guys, I know say una fit do am and I wan make una believe una self and make dis we country proud for all di match wey una go play for dis world cup and we dey una back"

Ronaldo don break anoda record as e make one history for social media

Image
 Christiano Ronaldo don enta headline again dis time for untop di internet as naim bi di do person wey people follow pass ontop Instagram. Dis mata make e clear say Ronaldo no dey follow record, na record dey follow am. Dis mata happen afta Ronaldo and Messi break internet wit one picture wey dem post as advert for Louis Vuitton. People jus shock anyhow wen di picture come out. Now Ronaldo don get 500million+ followers untop Inatagram. No bodi dey close to dat number of followers.

Qatar 2022: Games for today.

Image
 Di games wey go happen today go start for afternoon. Di first game na for 2pm between England and Iran. Di second one go happen for 5pm between Senegal and Netherlands and do last one na between USA and Wales. We jus dey enta real games so. World cup jus dey start.

Qatar 2022: Qatar chop am for di opening game

Image
 Di opening game for di 2022 start today ad Qatar wit Ecuador open stage wit di first game of di competition. Ecuador no even reason say na first game wit host country, na confam 2 goals Dem nak Qatar for di match. Qatar bin no try at all for di first half but for second half e con bi like say dem wan pick up small but Ecuador water don already pass dia garri. Na Valencia score di two goals wey di first one na penalty wey happen for 16mine before di guy score anoda one for 31mins. Oda games go continue for di 2022 world cup tomorrow.

Wetin bi your prediction as World cup wan start

Image
 As we sabi say tomorrow naim bi di deal day wey 2022 World cup go start for Qatar. 32 countries dem go face each oda for different groups A-H to take compete and to determine who e bi wey bi di best country wey go win dis year world cup. Wetin bi your own prediction for dis tournament. Which country you tink say go carry first, second and third?

Wayne Rooney send beta comment to Ronaldo even as e bi say Ronaldo criticize am

Image
 Rooney reveal am say im go like see say Ronaldo win dis World cup.  Dis gist by Rooney come even as e bi say Ronaldo jus finish explosive interview with Piers Morgan. For di interview, Ronaldo ya. Rooney say im dey always criticize am. Wayne Rooney don admit say im go like make im former Manchester United teammate win dis world cup. E go sweet I'm mind if e happen. Ronaldo wey enta interview with Piers Morgan dey provoke as I'm criticize many players wey dem bin play togeda for Manchester United including Rooney. Ronaldo say im no get any respect for Man U manager, Erik Ten Hag as im still yab di owners of di club say dem no care about football. Ronaldo tok say Rooney and Gary Neville dey jealous am. Im say e no know why Rooney dey jealous am maybe na unto say im career end for wen e jus dey enta 30 years but im still dey play for high level. "I no go tok say I even fine pass am, sometin wey bi say, na true." Na Wetin Ronaldo tok. Wen times of India interview Rooney

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal

Image
 Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal and im problem for Manchester United no go affect dia hope for world cup naim teammate Joao Mario yarn dis one. Di superstar wey blast Manchester United for interview wey im do before world cup start tok say, di club fall im hand and im no get any respect for Man-U manger, Erik ten hag. Ronaldo wey bi 37 years don readi to lead Portugal for di world cup  wey dey happen for Qatar and e bi like say naim last world cup bi dis. Ronaldo dey always dey happy wen e dey National team Joao Mario wey bi Benfica midfielder tell Reuters afta dia tainig for Lisbon. "I see am yesterday and e dey very fine as e sey always dey" e even tell me say "im happy to dey here" and im focus na on di national team

Four Managers wey fit bi replacement for Graham Porter for Chelsea

Image
 Chelsea manager, Graham Porter don dey serious wahala now as di team don lose three games back to back. Porter wey bi say na jus 3 months dem employ am for Chelsea, im leg don dey shake as Chelsea manager since di team start to dey experience tough time so. Owner of Chelsea,Todd Boehly say im no send anybodi and e fit sack anybodi jus as di former owner dey do wen Manager no dey try. But as e bi now, e bi like say di world cup break don save Porter small. Becos of di poor result wey Chelsea don dey gey even fans now dey ask say make dem sack Porter. Di four managers wey fit replace Graham Porter for Chelsea na: Mauricio Pocchettino Some of Chelsea fans fit vex of dem sign dis man as manager unto say im don coach dia direct rival wey bi Tottenham, but di man don prove say im sabi dis football work and e go do well for Stamford Bridge. Brendan Rodgers Rodgers appointment fit get plenty disagree for inside unto say dem bi almost sack am for Leicester. But di guy don make Leicester part o

Blatter say na 'mistake' say dem make Qatar host dis year world cup

Image
 Former Presido of FIFA,  Sepp Blatter don yarn say di decision wey dem take award dis year world cup give Qatar, na mistake. For 2010, di Exco of FIFA vote 14-8 make Qatar host di world cup instead of USA. "Na real mistake" na wetin Blatter yarn for interview wit AFC German sport subsidiary wey dia name bi SID. "Dis decision happen wen i still bi Presido and i accept part of di responsibility for am." Blatter say im bin Vote for USA make dem host di world cup, im con blame di before before Presido of UEFA, Michel Platini, wey swing di votes to favor Qatar unto as French Presido dat time, Nicolas Sarkozy, order am make e do. Sarkozy recommend Qatar give Platini make "im and im pipo vote for dem." Platini don deny di gist say, Sarkozy no tell am make im vote one country untop anoda one, im jus reason say na Qatar di former French Presido support. Na dis world cup for Qatar go bi di first time wey middle east country go host world cup and na di first time to

Games for EPL today

Image
 Nor bi only Chelsea eye see shege today o, Manchester United sef follow for di teams wey dia eye see beta shege dis afternoon afta Aston Villa show dem how e dey bi for dia villa. Aston Villa vs Man-U Villa break united waist dis afternoon afta dem win dem 3-1. Man U no expect wetin happen to dem as dem see pepper for Aston Villa hand. Even di 1 goal wey dem record for Man-U na still Ramsey of Aston Villa score am for dem. Southampton vs Newcastle Newcastle comot for dia house go use vexation flog  Southampton for dia own house. Na beta 1-4 flogging dem dem  Southampton as dem no allow dem breathe at all. Westham vs Crystal Palace . Westham score first goal for 20 mins, as na dem dey house, dem tink say peace of mind go dey afta di goal. But Crystal Palace get anoda plan for dem. For inside 41 mins naim Zaha shock dem before Olise seal am up for extra time (90+4) to make am 1-2. Most of di games wey happen today for EPL, na di away team carry winnings. Tottenham vs Liverpool . Liverpo

Arsenal use Chelsea head mop water for Stamford Bridge

Image
 Dis afternoon naim anoda derby happen between Chelsea and Arsenal. No bi today di two teams dey drag who bi baba for di city of London. Anoda opportunity show face today to confirm who di oga of London bi true true, but as di mata happen, di tin no favor Chelsea o. Gabriel deliver Arsenal from di hands of Chelsea for Stamford Bridge dis hot Sunday afternoon as na im im goal bi di only goal wey happen for inside di match. Chelsea fans dey disappointed for di result wey happen so as e no sweet dia belle at all. Incase you miss di match. Highlight of how di game take bi dey under so.

Wetin happen for Champions League yesterday (Group E) plus highlights

Image
 As yesterday bi di last game for di group stage of Uefa Champions League dis season, plenty tins happen as na yesterday some teams finally sure say, dem don qualify and for some oda ones, na have a nice day or straight to Europa. Di games wey happen yesterday: Dis one na for group E. AC Milan vs RB Salzburg. Na 1 point AC Milan take dey lead RB Salzburg before yesterday game, dem understand say to lose dat match no bi option for dem at all. Salzburg sef dey hope say, even if na 1 goal dem see take win, dem do qualify bi dat. AC Milan no allow dem see road at all as dem drop beta 4 hot goals for dia lap before dem know wetin dey happen. Las las, n Europa Salzburg dey go join dem Arsenal and Man-U. Chelsea vs Dynamo Zagreb. Wen dis season Champions league start, na dis Zagreb pipo fess show Chelsea shege, pipo con dey tink say Chelsea no fit reach anywia for di competition. Now, na Chelsea dey ontop di group table as oga as dem finish dia last group game wit 2-1 win untop Dynamo head. N