Posts

Showing posts from October, 2022

Barcelona Keeper, Marc Andre Ter Stegen, don set Ogbonge La-Liga record for dia win against Valencia

Image
Marc-Andre Ter Stegen don becom di first goalkeeper wey go record 10 clean sheets for di first 12 match inside season for dis century. Ter Stegen record dis clean sheet as Barcelona get goal for 93 mins from Lewandoski to win di tough match against Valencia. Na inside 2 matches di Barcelona keeper don concede since 2022/23 season start, against Real Madrid and Real Sociedad. Im don dey leave legacy for ground as one of di best keeper for La-Liga wit how im take start dis 2022/23 season. According as how tribuna gist am, Ter Stegen don enta history book as di first keeper wey go get 10 clean sheet for inside 12 matches for dis century. Di 30 year old German keeper don average 0.33 goals per game for La-Liga dis season. On di opposite side, dis same keeper don concede 10 goals for inside UEFA champions league dis season wey cause how dem take no see road qualify go next round for Champions League. Meanwhile, Newcastle don write open check for di keeper incase e get mind to comot for Barc

Dem don tell Barcelona Manager, Xavi Hernandez make e change im coaching staff

Image
 Barcelona Presido, Joan Laporta don tell manager, Xavi Hernandez make e change im coaching staff. Xavi bring im broda Oscar Hernandez from im former club, Al-Saad and naim bi im assistant. Barcelona no qualify for di knockout stage of UEFA champions league as dis one na di second season wey dem no qualify back to back. Bayern Munich destroy dem 3-0 for dia last Champions League game wey deny dem any opportunity to see next round. Dem don tell am make im change im coaching crew as dia hope scatter wen Inter Millan sef win Viktoria Plzen 4-0. Even as e bi say dem spend plenty money for summer, as dem don comot for champions league now, pressure don multiply untop Xavi head as he must make sure say im win La-liga and Copa del Rey by all means. Di Presido of di club believe say na im coaching crew dey part of di major problem wey no allow di team move forward. Dis Xavi elder broda, Oscar, naim bi im deputy wen e dey ASPIRE academy and Al- Saad as manager.

Arsenal destroy Nottinham Forest to reclaim dia first position for EPL

Image
 Yesterday, Arsenal bamboozle Nottingham Forest with 5 goals to reclaim dia top spot for EPL. Dem show Nottinham say Notin fit harm dem as dia name na Arsenal, all di fighting weapons dey ground. Man-City bin don dey untop afta dia game, pushing Arsenal go second but as Arsenal play wit Nottinham, dem show everybodi say dem no come to play. Marttinelli naim first open di rain of goals for 5 mins before Nelson add im own for 49 and 52 mins. Thomas con join anoda goal for 57 mins before Odegaard finally seal am up for 78 mins. Arsenal dey top of table wit 31 points afta dem don play 12 games. Man-City near dem wit 29 points. See EPL table for down_

Mega Match between C.Ronaldo and Messi bin almost happen

Image
 E remain small like dis make match between Team Ronaldo and Team Messi happen. Di match for give dem opportunity to choose dia own players and dem go play against each oda. Na one London based dealer bin propose dis €90 million game. Di project no finally happen because plenty parties bin want one tin or di oda plus join di plenty wahala of football politics. History go remember Christiano Ronaldo and Messi as two of di best football players for dis life. Di two of dem dominate football for Europe for almost 20 years wia dem break different individual record in di last 10years. Di two of dem don pass dia shine shine age and dis world cup wey dey happen for Qatar dis year fit bi dia last World Cup.  According as how di sun gist di gist, e remain small make two of dem play match against each oda for Wembley stadium wia dem go fit choose dia own team players dem. One book wey dem title Messi vs Ronaldo reveal di American style all star game wit Messi and Ronaldo as captain of dia own tea

Di kain flogging wey Chelsea collect dis weekend, we no sure dem go fit wake early tomorrow say

Image
 No bi small tin Chelsea eye see for Brighton hand dis afternoon o. Brighton make sure say say dem bright light sotey Chelsea almost blind. Na from 5 mins Trossard first tro sand enta Chelsea garri before Chelsea Man score own goal for 14 mins.  Chalobah sef still score anoda own goal, di tin con bi like say dem use own goal swear for Chelsea dis weekend. Havertz dey see wetin dey happen, di guy try for im own capacity to reduce the shame as im score 1 aa secondh beginning, for 48 mins. Na Grob from Brighton con silence di whole tin wit anoda goal for 90+2 mins to make am 4-1. Brighton no even tink about tomorrow, dem jus wound Chelsea anyhow like say SS3 dey follow Pry 5 play match. I sure say back pain go dey worry all di Chelsea players. None of dem go fit get strength to wake up early as Brighton break dia bone. Even dia fans sef, na so so crying since, person wey use im papa house run bet don hear am like this.

Arsenal loss to PSV expose some kain tins wey Arteta dey worry about.

Image
 PSV Eindhoven beat Arsenal 2-0 for dia match on Thursday for Europa league. Di defeat show somtin about di gunners wey do like suwegbe truout di match. If you look di team well, dem no get di kain strength and depth wey dey required to play for all competition dis season. For di first time inside dis season, Arsenal con bi like relegation team for di game wey happen on Thursday. Dis beating come from di hand of PSV Endhoven wey dia manager bi Ruud Vaan Nesteroy wey bi di former ogbonge player for Man-United dat year. Di scoreline for worse pass as e bi if to say VAR no rule out 3 goals wey PSV suppose get. Some Arsenal fans bin advise Arteta (Arsenal Coach) make e rest im best players as di guy don dey top table already for di group but im no gree, e still put all im players dia. Dis kain move show say dem no get depth at all. As tins bi now, Man-City don dey hot and for Arsenal to fit compete well especially for Premier League, di Manager must reinforce di team make dem no go lose gu

Samuel Eto'o don yarn say im beta pass im ex Barcelona team mate, Thiery Henry.

Image
 Samuel Eto'o don yarn say, im beta pass Thiery Henry wen dem bin dey play ball say im wit Henry no dey same level at all. As di African Icon yarn, Thiery Henry sef no beta reach Nicolas Anelka. Plenty pipo consider Henry as one of di beta players wey don play for English Premier League. For one video documentary by Booska- P wey leak naim Eto'o for yarn dis gist. Im say " Thiery Henry good, but i know players wey beta pass by far"  Im say im wit Henry no dey same level as im senior am for dis mata of football. We go remember say di two of dem bin dey Barcelona together as dem win plenty trophy together wit players like Iniesta and Messi join. Na dem bin dey shine for Barca dat year. Some pipo, especially Arsenal fans wey consider Henry as one di best players for English Premier League history no go gree wit dis Eto'o mata as Henry dey di top goal scorers for Arsenal history.

Barcelona dey eye to sign 19 players next season

Image
Despite say tins hard for Barca for now, financially, dem no wan hear say dem no go buy players. Na even 19 players dem dey eye now. As Bayern finally send dem comot for Champions League go affect di money wey dem suppose see but dat one still nor shake dem. For dis summer wey pass, na 5 players dem sign and di presido of di club, Joan Laporta don ready to back Xavi Hernandez wey bi di manager untop next season signing. Some of di make sense players wey Barca dey eye na, Joginho and N'golo Kante wey dey Chelsea, Dalot wey dey Man-U and Fabinho wey bi mid-fielder for Liverpool. E nor end for dia o. Ndidi wey bi Naija and Leicester midfielder sef dey dia list, join James Ward, Captain of Southampton and Rodri wey dey Man-City dey players wey dem dey observe.

AS Roma suspend Ethiopian steward wey go take picture wit Osimhen afta Napoli flog AS Roma

Image
 E bi like say Matteo Leo Cicero don lose im job as steward for AS Roma afta dem see am say im go take pictures wit di same man wey fuck dem up for dia game against Napoli. Di 18 years old guy happy as im see im football idol wey epp Napoli beat Roma for dat game. Di mata pain persin wey bi oga for Roma steward say, how can? You wey dey work wit us go dey snap pics wit our 'enemy' Osimhen wey bi man of di match for dat game last week sunday unto di kain ogbonge goal wey im score against Roma. Many pipo wey like football for di whole world don dey praise di guy unto how im take score di only goal for di match from angle wey dey impossible. We see am say afta di match, Cicero near Osimhen, dem gist small before Osimhen and am take picture. Na later gist con dey clear say na Nigerian Sports reporter, Oma Akatugba carry Cicero go meet Osimhen, na den we con still know say Cicero na Napoli fan wey see job with Roma. Osimhen tell Cicero say make im no worry, make im give im numba to

Wetin happen for UEFA Champions League on Tuesday

Image
 If u nor watch di matches wey happen for Uefa Champions League yesterday, wetin u miss, na only u know am o. Plenty matas sup yesterday as different teams vex. Chelsea win Salzburg for house, PSG still open di windows of goals untop dia opponent head. Na di summarize of wetin happen bi dis: Salzburg vs Chelsea. Chelsea vex dis time o. For dia first 2 games for dis season Champions League na only 1 point dem see. But for di last 3 UCL games, na winning  levels Chelsea dey o as dem first beat AC-MILAN home and away, na Salzburg chop dis on again as Kovacic score fo 23 mins, before Adamu fo Salzburg return am. As match enta 64mins, Harvetz score wit fantastic strike from outside box. Sevilla vs Coppenhagen. Sevilla no gree at all as dem make sure say dem win di game as mata don dey enta new level as disqualification dey near. Even as e bi say na thrid dem dey now wit 5 points dem dem still get hope for di remaining 2 games if dem no dull. PSG vs Maccabi Haifa. If dem say persin collect f

Arsenal dey on top for everywia now

Image
 Arsenal FC don continue dia leading dis week as dem still dey maintain di top position for English Premier League for dis season even as e bi say dia last game against Southampton na draw dem see.  Arsenal men's team still dey on top di table wit 28 points from di 11 game wey den don play so far. Man-City dey dia back wit 26 points. For UEFA Europa League sef, na Arsenal still dey top for dia group wit 12 points as dem don win all dia 4 games so far for group A. Even dia women sef no carry last for dis mata as na den dey top for di women's league wit 12 points afta 4 games. Even join di women's champions league na dem still dey on top wit 3 points as dem win dia 1st game. Juventus dey dia back wit same points.

Wetin happen for EPL on Saturday.

Image
 Na di gist of how mata take bi for games wey happen for Saturday for EPL bi dis. Nottingham Forest vs Liverpool. Liverpool bin dey reason say notin go fit ham dem for di forest wey den go play for on Saturday but dem lie! Di mata shock dem as Awoniyi pour beta sand for dia garri to make Nottingham win di game wit im  goal for 55 mins. Everton vs Crystal Palace. Everton no even waste time to show Crystal say no bi dia Palace den dey. Na 3 hot goals Everton take show dem say e get why khaki no bi mate wit leather. Na from 11 mins Lewis start to dey roast dem crystal wit extra 2 goals wey still enta from Gordon and McNeil hand before match enta 90 mins. Man-City vs Brighton. Man-City no even give space for dia visitors to 'Bright' any 'Ton'. Haaland wey no dey use eye see net first tear dem di first goal for 22 mins Before Man-City see penalty wey bi say na Haaland still take am, score am join before De-Bruyne top am for 75 mins. Brighton sef say make e no bi like say den

Osimhen don carry Napoli go front for Serie A as im score do only goal for di game

Image
Na Osimhen name dey hot right now for everywia for Italo dis evening, even social media like Twitter sef no gree rest ontop di mata as Osimhen push  Napoli go numba 1 for Serie A table as im score di only goal for match wey bi say e tough no bi here. Roma no see single shot on target for first half and na so dem even struggle afta di break. Na dia Napoli start to threaten dem small small. As e bi now, Napoli dey numba 1 as AC Milan dey dia back wit 3 point gap as Napoli win dia 11th game back to back for all competition. See dia table...

Wetin happen for English Premier League Yesterday

Image
 Na di summarize of di matches wey happen in Sunday, 16/10/2022 dey here so. Southampton vs Westham Southampton sharply score Westham for inside twenty minutes make den for fit win di game without story. Na as dem enta 64 mins for di match, Rice say no?! Make I cook small jollof for una make una rest. Na so e load dem beta equalizing goal wey con make di match end for draw. Manchester United vs Newcastle Newcastle find Manchester come house, nothing wey Manchester use dem do. For di end of di game, two of dey united to draw. No oga for di mata. Leeds vs Arsenal Arsenal still neva wan cool down for dis dia top position o, as dem dey try make sure say dem win all di games wey dey before league start to dey hard. Arsenal find Leeds go house con reach dia go still lead dem wit goal from Bukayo Saka wey enta for 35 mins for inside first half. Aston Villa vs Chelsea . Chelsea sef nor wan rest for winning mata o. Di tin dey sweet dia new coach as dem go Aston Villa house go spread like say na

Karim Benzena win Ballon d'or as Putellas win women own

Image
 Karin Benzema don win dis year Ballon d'or wey bi reward of ogbonge game wey im play for Real Madrid. As Putellas sef win di women own. Dis award na for inside Paris for France dem give dem so. Benzema wey bi di first French man wey go win am since Zidane don win am last for 1998, score 44 goals for 46 games for im club last season as dem win di UEFA Champions League and La-Liga. Fifteen out of di goals wey im score na for inside Champions League e score dem as hat-trick enta for inside different games as dem win PSG, Chelsea and Man-City for knockout. Na Benzena collect am afta Messi collect im numba 7 Ballon d'or  last year. Dem no nominate am for dis year own at all. Na Sadio Mane collect second for di mata.

Manager of Everton club, Frank Lampard don confam say dem dey tok about contract wit Super Eagles Star

Image
 Contract wey Alex Iwobi get wit Everton go finish for 2024 summer. Di Nigerian international don dey hot since Frank Lampard begin coach di Goodison park side. Now dem dey tink of how dem wan extend Iwobi contract to tie am down. Iwobi don develop imself to reach level wey bi say e dey one of di best midfielders for Premier League and Everton no wan hear say anoda team dey find am. Even as e bi say im contract wit dem still bi 2024, dem still wan extend am to tie di 26year-old down.  

Tuchel reject coach work for 2 premiership clubs

Image
 Thomas Tuchel wey bi former Chelsea manager don reject job from 2 premiership clubs. Tuchel still don reject work from one La-Liga club and even Bayern Leverkusen bin wan employ am, but di guy no gree. Na for September dem sack am for Chelsea wey bi say na instanta Chelsea find anoda manager, Graham Porter, replace am. E bi like say Tuchel decide say im wan jus dey for now or make e bi say wetin di clubs dem dey offer am nor reach wetin di man dey find. Na "the Telegraph" drop dis gist and dem nor drop di name of di clubs wey Tuchel say NO to.

Chelsea Mid-fielders James, Kante fit miss 2022 world cup

Image
 Chelsea coach, Graham Porter don yarn say Ngolo Kante and Reece James go need see specialist wey go determine if dem go fit play for world cup or not. James wey bi England right-back, limp comot for field as e injure for knee for di match wey Chelsea take win AC-Milan 2-0 on Tuesday as media pipo dey yarn say e go hard for di 22 year-old James to fit play for Qatar. "Na dis weekend e go see specialist and before day time I go fit give any informate about di mata" na Wetin Potter tok about James wey don make imself first choice of England coach, Gareth Southgate as right-back. Kante Neva play game since August wey im get hamstring injury. Kante dey important for how France take win for 2018 and e go bi big miss for Didier Dechamps side if di guy no later play.

Francia Uzoho don receive plenty praise as im save plenty goals against Man-U for dia Europa game tonight

Image
 Francis Uzoho wey bi keeper for Omonia Nicosa don dey plenty pipo mouth dis night as e bi say im try well for dia match against Man-U for Old Trafford. Uzoho wey bi Nigerian international keeper silence Man-U players like Christiano Ronaldo, Marcus Rashford and Casemiro as e deny dem goal before Man-U struggle to win dia game for dia home. Uzoho wey bi Nicosa back-up keeper save ball wey so tey, dem con dey link am wit great keepers wey hot well wen dem dey gor young.  Dem compare am to star  keepers like Buffon and Manuel Neur wey dey catch anytin for time wen dem dey hot. Na united get possesion pass for di game but Uzoho deny till almost stoppage time before dem manage see one score. Some pipo even dey yarn say, abi Uzoho wan replace De Gea?

Bi like say Chelsea dey find how to sign Kylian Mbappe

Image
Mata wey connect Mbappe transfer don dey hot for Europe now as e don show say di guy no happy for PSG wia im dey. Gist dey say di guy no dey good rapport wit PSG ogas dem few months afta e sign new contract. Chelsea dey part of clubs wey dey monitor how tins dey go wit di Frenchman.  Liverpool sef dey one corner dey eye di 23year old.

Sergio Ramos wife, Pilar Rubio wey bi Model and TV presenter yarn say na everyday she and her husband dey do kerewa

Image
 Sergio Ramos wife wey bi fine TV presenter plus model don yarn say na everyday im dey run show wit di PSG central defender. Di  former Real Madrid defender and im wife, Pilar, wey dia 4 children bi boys, marry for 2019 inside Seville Cathedral afta dem don dey date for 7 years. Meanwhile, im husband wey don make name for himself as ogbonge defender enta news recently unto say e collect im 28th career yellow card for di match wey dem play against Reims. Pilar, wey bi mama of 4 boys no shy wen dem dey ask am all dose kain questions. She say na everyday show dey happen except wen she dey Madrid. She say her children no affect aw dem take dey run show as dem go don sleep for 9:30pm wey show go start.

Wetin happen for Uefa Champions League yesterday + Highlights

Image
 How una deyyyyyyyy???? Yesderday hot as e wan bi o as Chelsea trash AC-Milan again, 2 times inside one week naim chelsea dash dem 5 goals! Dem no even fit score any one back. Many many tins shelle yesterday for the games wey happen across Europe. Di summarize dey down so. AC Milan vs Chelsea.    08:00pm Chelsea don go Milan to win AC hands down. Yesterday night hot as Chelsea show the Italians how e dey bi for London. Jorhinho see penalty as Tomori use head carry red card before Aubameyang seal di day wit im goal for 34 mins. PSG vs Benfica.    08:00pm Bi like say na wetin follow PSG go benfica house still follow Benfica come PSG house. Na Mbappe fess score before Mario return am. Na penalty di two teams see for di game. Dortmund vs Sevilla.    08:00pm Di game no eazi fo most teams yesterday as na draw still end dis game. Na 1-1 w end as Bellingham and Nainzou score 1 goal each for dia team Shakhtar Donetsk vs Real Madrid.  08:00pm E no easy for Madrid as we tink say e go bi yesterday